Top Advert

Erigga – COCAINA PATIENT Lyrics

ALBUM: Erigga - G.O.A.T
ALBUM: Erigga – G.O.A.T

COCAINA PATIENT Lyrics by Erigga

Police don block the motor make nobody come down
We been sit down outside Dey argue front of we compound
About Ronaldo, Messi money when we hear the gunshot
We feel say na play till we run reach Cynthia mama shop
3 boys mask up kporkpor use them lie ground
Be like film for we eye na better machine dem carry
Use police run better race, but as dem reach that sharp turn
Kuti play follow them, who drive na bros Batare

Baby Benz Sharp one them spray the top black
Birge interior this na when that motor newly come
Na one Ijaw man then go Rob, dem follow am from bank
E just dey come from ecravos, shell pay am millions
Them say na one person for plaza nai give them the line
According to who go station when dem admit the crime
Area don gather for snooker board around nine dey judge
Say emma fuck up big man pikin which money e dey find
Around 9 you go see guy man don powder nose
No be say na make up artist if you know you know
Eye Dey red tru window e Dey shale people phones
Wan fire ice as I Dey talk na my shoe Dey him leg

Cocaina patient
Cocaina patient
Trouser Dey ground belt Dey waste
Dey talk plenty
Cocaina student
If you see them you go know them
Trouser dey ground belt Dey waste
Dey talk plenty Cocaina patient

I Dey my snooker board Dey smoke carry problem come
My people no run we curry area you know how the matter be
Na money matter we Dey talk and u know say head burn
No worry blood I Dey with you leave everything for me
Swipe right swipe left na you get choice
Anyhow you wan live your life na you get voice
You no fit Dey motor wit me dey say you Dey ur lane
Na the same place we two Dey go no use ur life do toys
When gen off everybody go remove their phone
Carry their charger Waka oko na so life be
Carry your passport no be only stand alone
For cufffin na only you Oko Dey use ur Ip

Cocaina patient
Cocaina patient
Trouser Dey ground belt Dey waste
Dey talk plenty
Cocaina student
If you see them u go know them
Trouser dey ground belt Dey waste
Dey talk plenty Cocaina patient

The post Erigga – COCAINA PATIENT Lyrics appeared first on tooXclusive.

Disclaimer:
The opinions presented in this post are those of the mentioned author. The content has been sourced from TooXclusive, and due attribution is provided to the company.
If you wish for us to take down the content, kindly get in touch as soon as possible. This content is for promo purposes only.

PLAY GIF2 DOWNLOAD GIF

Post a Comment

0 Comments
* Please Don't Spam Here. All the Comments are Reviewed by Admin.